Except say plans change, we Presido Muhammadu Buhari suppose show back we country today from London. Na 2 Mondays ago, Baba don commot go do 10-days holiday. The office of we Presido for one statement wey dem sama public say presido go for United Kingdom, see pipu wey Sabi about Ear, Nose plus Throat cos he get issues with hin specialist ears, and the 10 days holiday don finish since Wednesday. One person for inside the office of we Presido, wey no wan make dem mention him name say dem don ready to welcome Baba back today.
No comments:
Post a Comment