Thursday, June 16, 2016

SARAKI DON CARRY ANODA MATA COME TO PURSUE TRIBUNAL CHAIRMO

Federal Government no gree for the application wey Senate Presido, Dr. Bukola Saraki, say make dem commot the Chairmo for the Code of Conduct Tribunal, Danladi Umar, make he no siddon upon him mata again. Saraki, through him lawyer, Chief Kanu Agabi (SAN), carry him fresh letter on June 13, 2016, dey accuse Umar say he yarn wetin make am feel say he go do Ojoro when he dey yarn on June 7, 2016, when Dan lady dey want him Lawyer make he no dey waste time again, say make den do sharp sharp, so wetin the guy go hear afta the mata no go too much. Saraki for him fresh letter say wetin Umar yarn din show say him no go judge the mata well. But dem say na lie, wetin Umar yarn on June 7, 2016, wey SarakiSaraki wan come take pursue the Oga chairmo for the mata.

No comments: