Thursday, February 25, 2016

SKIBIROBO... SKIBO.. LIL KESH SAY HIM ALBUM GO DROP NEXT MONTH

For all of una wey be fans of the Ibile guy wey don dey get hit back to back from tey tey, he be like say the badt guy don ready to scatter una waist next month wey be March. He don polongo say him album dey drop next month and the title na Y. A. G. I. (young and getting it). So YBNL don ready to shake Naija once again and as per say we sef no dey dull,  we dey wait dem. But make we no lie,  he be like say dem don take hit swear for the guy,  him and dat him wicked producer, Young John. We dey wait for dem,  make God no kill us.

No comments: