Wednesday, April 13, 2016

SHUU... SOME CHIBOK PARENTS COLLECT CALL FROM THE LINE OF DEM PIKIN WEY DEY MISS

5 parents of the Chibok schoolgirls wey dem kidnap don collect call from the phone numbers of dem  daughters wey dem no see again. Tori yarn us say the parents halla the line back but pipu wey pick am dey tell dem say no be dem. The Chairmo, Chibok Community for Abuja, Tsambido Amana say the community plan to report the mata to the government make dem shine light put. He say dem no Sabi if the phone company don give other pipu the numbers ni  abi na those pipu dey take the parents play. But Sha Abana say dem no fit confirm when the parents collect the call, say na just on Tuesday he hear about am. But on 16-year-old girl, Fati wey God save afta she do 2 years for Boko Haram dommot dey explain how the girls dey hustle to go kpain pipu so dem go fit free from the yeye things wey the Boko boys dey take dem do. She say the girls dey wan die,  not because dem don touch dem brain but becos of the suffer wey dem dey suffer for Boko Haram hand.

No comments: