One of the ogbonge Radio voices for Ibadan, wey still be Comedian and one of the pipu wey Lagelu FM import come take hold dem station, Promise Nero wey everybody sabi as Dr. WARRI CONNECT don ready to ginger Ibadan City with one monthly show plus groove wey he call Open Mic Talent Show. For pipu wey don Sabi the bros tey tey, since the days of Wazobia FM and for Yotomi Express wey he dey do now for Lagelu FM, dem sabi say Dr. WARRI no well. For one of him shows, Fridays of lafta na there pipu dey call dey show dem talent, e be like say na dat one ginger Dr. Warri to start the show. From the polongo wey he do, he say make all of us for Ibadan dey ready for Fun wey go dey shele every last Sunday of the month for Mingles Lounge, Magazine Road, beside Sterling Bank for Jericho Road. He say na music, comedy plus dance go dey shele for there and anybody wey win am go dey chop beta Awoof. But he Neva yarn us when the level go start. So make we dey shine we eyes dey wait front he ginger wey Dr. warri wan take decorate we city. For anybody wey get interest, dem say make he call... Call +234(0)8090909290
No comments:
Post a Comment