D world boxer Muhammed Ali na hin come world 4 Jan. 17 1942. Hin name wey be Cassius Clay Jr. Dem born am 4 hin local government 4 louisville kentucky. Hin papa na painter, hin mama na cleaner n cook 4 One rich family. Ali dey stay 4 middle class black neighbourhood 4 kentucky as e be say d white dem no gree make d blacks share anythin with dem.
Ali begin worry n begin ginger as one 14 yrs old Emmett die 4 1955 becos of race palava. During hin birthday again hin parent gather small change buy am one bike make hin dey use am flex n paint town red small. Na hin dem thief d bike o. As Ali go report d mata give one police man wey Joe Martins. Joe Martins wey be boxer too. Ali begin lament say na beta beat hin go give d thief if hin see am. But Martins yarn Ali say 'u beta go lean boxing b4 u begin make mouth na only dat one go fit mke u beat d thief. na dat one go make sense' no time Martins begin train Ali
E no Tey Ali begin win small small tittle, chepe chepe 4 amateur boxing circuit under Martin coaching. As in clock 18 Ali qualify 4 Olympics 4 Rome as hin enter media dis one com make am popular among hin mate n hin fellow athlete. As hin mouth no fail am Ali finish work as in win d gold 4 d light heavy weight champion. Afta hin collect d medal e no gree rest na so hin begin wear am about 4 Italy n even wen hin reach hin coutri US. hin Pipu 4 hin local govt area arrange parade 4 am 4 louisville, but dem bounce am 4 d white dinner party n other functions as race no sabi medal champion or no champion na 4 ya pocket
Ali no gree give up Afta hin victory 4 Rome Ali begin get liver con begin masters training to dey dudge blow as hin burst media an hin fans begin predict hin match. He con begin face tough opponent Henry Cooper wey use hin left punch scatter hin face but Ali no give up as e sure 4 am. He yarn say time dey come wey hin go beat hin toughest opponent.
As time dey go hin religious belief begin get weight as in get rapour with d civil right leader n d Islam member. Afta hin beat liston hin Comot say hin na member of d religious movement. Na for March dem nack d name MUHAMMED ALI as e be dey bear CASSIUS CLAY befor. Hin spiritual mentor Elijah Muhammed na give am d name. Ali say ' CASSIUS CLAY na slave name I no choose am, I no want am I be MUHAMMED ALI'.
As war shele 4 Vietnam Ali receive alert say make hin com join Us army hin say 'God forbid' as in turn down d offer of which hin get fight dat period. D fight happen 4 One courtroom. Ali enter soup as d US govt make eba 4 am collect hin medal con push am enter prison 4 5years as dem place fine of $10,000 4 1970. Ali show background beat Jerry Quarry n Oscars bonavena con meet Joe Frazier. As him n Joe drag am no be small as dem becme d two elephant of der time as r Pipu wey fight against racism
Still on d fight for madison square garden as million is Pipu con watch Frazier finish work as hin beat Ali to stupor win 15 rounds. Na Ali first time loss ever. As e yarn ' I don follow whale play I don put fire 4 handcuff n I don throw thunder 4 jail'
Mata never finish o as Ali dey on a Misson to reclaim hin title back, e charply beat George Forman wey over 80,000 fans con watch. He quickly introduce one new style ' D rope a dope' as na hin masters result 4 hin training on how 2 dudge blow. E beat George like small pickin 2 d package wey be say BBC dey shout 'o my God' eight round he win d title back no time at age 32.
' I no dey call am best boxer of our time but na d greatest person wey i Don meet 4 my life' na George yarn dis one. Elvis, Bertrand, Russell, Nelson Mandela becme hin fan. Dem call Ali make hin show 4 white house as Presido of US dat time Gerald ford invite am. Ali Comot frm nation Islam enter orthodox Islam as hin say ' as hin say black no dey make man devil na hin heart n mind dey make am'
Na 21 month na hin Ali n Joe win d fight as 1-1. Ali begin call Joe 'gorilla' as tension begin holo der two 14 rounds no be small thin as Ali describe d fight say na 'fight wey close to death hin experience so'
Ali carry medal six times b4 hin drop am to leon spinks one fighter wey no get shame wey win seven fight at a go. Ali no gree seven month later Ali show back 4 Sept 1978 beat dis same man leon spinks as hin reclaim hin medal. Afta hin retire small e still con make mouth to Larry holmes e meet am but no finish d fight Afta 10rounds as in coach advise am. Still record never clean e win 56times con loss 5 times
Ali proclaim hinsef as d 'World Greatest' of hin time, marry 4 wives over 9 children suffer frm parkinson disease + respiratory wahala. He turn philatropist meet Nelson Mandela 4 1990, collect d highest tittle 4 America as d presidential medal of freedom still be diplomat D world go miss am no be small as hin quote don push Pipu forward don even put somen Pipu inside boxing RIP .
I 4 like be like am but who I go beat ???? MUHAMMED ALI na d WORLD S GREATEST.
#oginibernard#
No comments:
Post a Comment