Wednesday, June 8, 2016

PDP GBEGE : SHERIF NO GREE MAKE DEM BOT CARRY PARTY SECETARIAT GIVE CARPET AKETI COMMITEE

National Chairmo PDP wey dem don pursue, Senator Ali Modu Sheriff, no gree on Tuesday make dem handover dem party secretariat give the Ahmed Makarfi-led Caretaker Committee. PDP members wey dey  support Oga Sherif wey be Borno State Governor before, yarn wetin dey happen for Abuja on Tuesday. Sheriff and him pipu dey yarn on top say dem wan handover party secretariat give the caretaker committee by dem Board of Trustees earlier that day. One of dem members wey get mouth, wey still be before before National Secretary of the PDP, Prof. Wale Oladipo, for one telephone interview with The PUNCH, say the handover ceremony na yeye, sake of say na illegal something , as dem no follow wetin all the plenty court cases dey yarn on top the mata.

No comments: