Niger Delta militants on Thursday don go bomb 2 oil pipelines again for Bayelsa State, and dem say we still never see anything O, na finish dem wan finish petrol for Naija. Niger Delta Avengers wey dey blow anything since dis year start, say dem don still hayaj 2 crude pipelines wey one Italy company oil Eni get. Na on top dem Twitter handle @NDAvengers dem write am for dat kain 2am say dem don blow up the Ogboinbiri to Tebidaba and Clough Creek to Tebidaba crude oil pipelines for Bayelsa State and dem say Dat one still dey follow dem promise wey dem do give all international oil companies plus indigenous oil companies say Nigeria dem wan finish oil production for Naija. Na on Wednesday dem go blow up 2 properties wey belong to Chevron Nigeria Limited, and na Dat one go make am the fourth time wey dem go hayaj major property wey be for oil companies. All join wetin make we Presido, Muhammadu Buhari cancel him waka to dat side by last minute on Thursday. Vice Presido Yemi Osinbajo na him come travel instead of Buhari, where he go launch the clean-up programme for one are wey plenty oil for throway, and he say dem ready to work to stop militant hayaj.
> Till now dem never yarn us wetin make presido change him mind.
Friday, June 3, 2016
NIGER DELTA AVENGERS DON STILL BOMB PIPELINE FOR BAYELSA O
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment