One court wey dey siddon for Akwa Ibom on Thursday don free Mr. Odudu Ukpanah, wey be pikin of one Peoples Democratic Party chiefo wey don die, Albert Ukpanah, sake of say he kpain person. The judge wey siddon on top the mata, Justice Ezekiel Enang, say the mata wey dem carry come against Odudu by the police and the Akwa Ibom State Government no get leg, as dem no fit prove am, Dat na why dem free am. Odudu, 33, get master's degree from Coventry University, United Kingdom, and na him be the only pikin of the late Ukpanah, and dem say he kpain him Papa when Godswill Akanbi be Governor. Dem kpain Ukpanah on Wednesday March 12, 2014 for him house. Report wey police drop on March 25, 2014 say politics hand dey on top the mata wey kpain the Baba.

No comments:
Post a Comment