Miss Simplicity - My waka carry me nack for Nollywood doormot again nd na Bimbo Akintola wey be ogbonge actress naim I meet as she tanda for d door wit her smile to take welcome me o naim com make me put ear for wetin she dey tell sum pipu wey dey ask her abt hw she take start to dey act film oo.
She tok abt how Joke Silva wey be d wife of veteran actor Olu Jacobs take help her acting ministry o..
Ma'am Bimbo tok sey her papa bin no wan gree make she be actress before o on top sey d papa bin believe sey pipu wey dey act no dey get moni oo. She tok sey she nd her papa argue well well o before she com tell mummy Joke wen dem two dey act togeda sey her papa tok sey make she go do English or any oda tin for skul o. She tok sey aunty Joke tell her sey make she bring her papa come watch their performance o. Hmmm ma'am Bimbo tok sey wen her papa meet mummy Joke Silva, he dey impressed o sey if na pipu like mummy Joke dey act, then him pikin sef must act oo nd sey from dat time her come dey support her acting o.. Last last She tok sey na mummy Joke Silva naim ginger her papa wey d man take let her dey act o nd sey dey grateful to her oooo... See sum pinshures wey she sama us join d tori

No comments:
Post a Comment