Friday, June 24, 2016

WAIT O, JULIET IBRAHIM WAN STOP TO DEY ACT ABI NA WETIN MAKE HER WAN DO NEW BUSINESS AGAIN???

Miss Simplicity - One road no enta market naim make Juliet Ibrahim wey be Nollywood/Ghallywood actress, film producer, singer nd humanitarian wan do anoda business join her acting o. She tok sey she go soon join of list of actress like Omotola Jalade, Genevieve Nnaji Mercy Aigbe nd many odas wey be fashion entrepreneurs o base on sey she too go soon launch her own eyelashes nd lipstick line o. D actress bin get Fashion house wey she call House of Glamour o bt now she wan add her new product wey she call Juliet Ibrahim Moda Lipstick line nd shades o.... Juliet Ibrahim bin win d Best Actress award for 2010 Ghana Movie Awards wey make dem com dey call her the "Most Beautiful West African Woman o...now she wan add anoda feather to her dress wey beta beta fine fine decoration don dey before... From d TPN stable, we dey sey congratulobia to u ma'am Juliet....

No comments: