Monday, March 28, 2016

SEE WETIN ADENIYI JOHNSON USE STYLE TOK GIVE HIM BEFORE WIFE TOYIN AIMAKHU .




MISS SIMPLICITY - E neva too tey wey Toyin Aimakhu kawasaka comot for her new guy Segun egbegbe place nd d guy don dey threatened sey her career don finish, he sey he go spoil Toyin career. Adeniyi Johnson come post sum sweet advice for him instagram. He tok sey "upon all d tins wey u dey do, wetin u don gain? Na man dey plan bt na God dey make ham work, me I be person wey God dey wit, naim make He dey save me" 


He com still tok sey make we be careful o, make we no go lose crown wen we dey run afta wig bcos wig o, e go fade bt crown go forever dey kampe sake of sey crown go always give person confirm respect..Hmm e go be like sey he dey give pipu advice bt wetin he com take finish ham get meaning die nd d tin point to Toyin.. "Only d wise go fit relate...Hmmmm oga Adeniyi I dey feel u, me sef don learn from dis advice ooooo.

No comments: