AFOUDA - If you ask your Papa and Mama, dem go tell you say Ibadan no dey carry last for entertainment for Naija. But for some time now e come be like say Ibadan dey dull. Many pipu don yarn different reasons why dem think say e be like dat, and one of the reasons wey plenty pipu dey give na say pipu wey dey run entertainment for Ibadan no dey gree for each other, dem no dey take one voice talk, dem no dey support each other like that like that. Many times, different pipu don try gather pipu wey get mouth for Ibadan entertainment but for different reasons e no dey work. But finally, e be like say God don use government bring dem together one kain one kain, cos for the first time afta a long time, Ibadan entertainment stakeholders gather mouth halla government when government wan start one kain play wey no funny say make pipu dey come collect permit before dem go fit do event. Thank God for that thing as e come be like say since den, pipu wey get mouth don see clear reason why dem suppose dey together.
Confirm tori wey dey reach TPN hand be say dem don dey mobilize, try reach out to different association wey relate to entertainment, make everybody gather together. We still confirm say pipu wey dey arrange am, dey really try carry every body along, so dem don reach out and still dey reach out to pipu wey get mouth for entertainment mata wey Oyinbo dey call stakeholders. And from how e dey be now, e too sure say the thing go work cos many pipu don already dey buy the idea, at least for the last 2 meetings wey dem do now, many many big names for Ibadan entertainment don dey show face and dey show interest. So if you dey do anything wey relate to entertainment for Ibadan, no gawk am O, sharperly jump enter the train before e full like Noah ride for inside Bible O. If you no Sabi how, ask other entertainers wey be your Padi, one person must Sabi one person wey Sabi.
No comments:
Post a Comment