Police for Thailand don catch one Naija pikin, Oga police Lt.Col.Chitdecha Songhong- wey be Deputy superintendent for Na Jomtien police station, say na gist dem sama dem, wey dem take catch am. Na one local drug agent wey dem catch point am give dem, na so one officer come go form like customer wey wan buy for front of one McDonalds shop.
Na so the police guy go block Chinedu wey Waka with him wife wey be Thailand pikin. As he see say na set-up, he wan clear, naso he take him car go jam 2 villagers. POLICE chase am til dem finally catch am for Soi Sukhumvit 46 road. But him babe carry the drugs run. Chinedu say no be today, he don tey wey him and him babe dey do the business.
No comments:
Post a Comment