MISS SIMPLICITY - The veteran actor wey we know as RMD wey be 54 yrs old nd wey be politician naim take him time post some promo photo for him page dis morning wey him rock blue jeans, blue T-shirt nd red loafers nd for d pictures him write sey " The King is Back" nd he still tok sey him na producers nd directors toast o, him na one actor wey other actor dey like to work wit o nd many pipu
dey like watch him films o. RMD come still tok sey if person fit rule d movie industry for time wey pass three decades then na person suppose get title as " The King. Yes ooo, na true tok RMD yarn o base on sey him na king for wetin him dey do o nd no be sere sere d guy na king..
.una dey feel ham???
No comments:
Post a Comment