E be like say Terry G don finally do him grappa enter one chance O, as all DJ for Naija plus dem Padi don talk say none of dem members should play any song by Terry G again O. Dem say dem even dey carry am go court sef. Wetin he do like dat na, one statement wey DJAN, Deejays Association of Nigeria sama the public and wey dem sign by dem National Secretary, Sebastian Ikpoza (DJ Desert Storm) dem say na last Sunday 5th of June, the mata shele for Bash Comedy show wey happen for Onikan Center, dem say na beg Terry come beg make dem allow am perform O and dem give am 7 minutes but he no gree commot stage afta 18 minute, na him dem say make DJ scratch anoda song take commot am for stage. tori say na so Terry Ginger go hayaj the DJ wey be Oga DJ for Jatt Incorporated wey DJ Jimmy Jatt get dem say even Jimmy Jatt dey stand there and he no fit do anything Dan to just dey look Terry G wey don high, dey misbehave dey woundjure him boy. So all DJ say dem wan take am do scape goat for all the artiste wey no dey respect DJ. So dem don nack embargo put for him songs and say dem go still take legal action.
Wednesday, June 8, 2016
LOBATAN... WHY NAIJA DJ DON PUT EMBARGO ON TOP ANY TERRY G SONG
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment