Man no die, man no roti. Life be like bum short, d more u dey wear n wash am d more e dey short. D more u dey live life d more e dey short.
Stephen okechukwu keshi don collect ticket to d great beyond as old men dey announce. At d young age wey old age suppose begin 54yrs. He Park hin load Comot dis early morning June 8 Wednesday 4 Benin Edo state Afta hin Don dey fight one wahala wey oyinbo dey call am cardiac arrest. Stephen Chinedu okechukwu keshi Delta by DNA, lost hin 35 yrs old Wife Mrs Kate keshi 4 9th December 2015 2 cancer. Ever since den Steve no balance again.
Steve wey hin nick name na 'big boss' na only him be d naija coach wey Don collect African cup of nation. E still becom d second persin 2 win am as a player n coach Afta Mahmoud El- Gohary of Egypt show hin sef 4 south Africa as hin win am 4 2013. Enter national team at age 20. Him wey be central defender don score 9 goals. Drop boot 4 1994. Enter Togolese national team as coach but sack am as dem replace with one German machine otto pfister.
He reach hin dream 2 coach d super eagles 4 d tournament 4 world cup 4 2014. Stephen okechukwu Chinedu keshi get 4 pickin with hin mama. Man no die man no roti. Life be like bum short d more u live d more e dey short.
Stephen okechukwu Chinedu keshi. May ya soul rest 4 confirm peace

No comments:
Post a Comment