Monday, June 13, 2016

HMM... 50 PIPU KPAIN FOR SHOOTING WEY SHELE FOR GAY NIGHT CLUB FOR FLORIDA

One gunman wey yan say hin support ISIS open fire for yesterday morning for inside packed Orlando nightclub, wey con kpain 50 people plus wound at least 53 more for the shooting wey dem call deadliest mass shooting in modern U.S. history. Omar Mateen nahin be the name of the man wey be the gunman for the Orlando nightclub shooting. ISIS don claim responsibility for the attack yesyerday  afternoon via den Amaq news agency, Reuters still con report. but den never sabi wether na na ISIS direct the shooting or say na dem just inspire am.
The attack for Orlando inside Pulse gay bar, hin dey filled with more than 300 people for "Latin Night," Na wen the police enta the place con kpain the shooter before the killing stop.

No comments: