Thursday, March 24, 2016

AFTA 25 YEARS IN MUSIC, SEE WETIN ARA WAN SAMA HER FANS




MISS SIMPLICITY - Ghen Ghen...the popular talking drum female musician Ara don ready to hit pipu wit her ogbonge new album afta 25yrs wey she don dey sing. Nd on top d mata, wen dem ask her sey y e be sey na afta 25yrs she dey bring her first album out, Aralola Olumuyiwa wey we knw as Ara tok sey wen she meet her former record label oga 25yrs ago, she bin think sey na d best tin wey go ever happen bt she com see sey dem dey try cage her base on sey dem no let her make frds, 


even her family no get access sake of sey dem wash her brain for her... She com still tok sey she don sing for countries like US, Paris nd Ghana, dem no still let her bring her album come out, bt she tok sey even tho dem bin dey threaten her life then, she don ready to hit us wit her album wey get 20 tracks. She tok sey make we dey put eye for road dey wait d album o bcos pipu like 2face nd Pasuma go join for d album nd d tin go come out soon from popular producers like Wole Oni, Puffy T nd Ty Mix.... Hmmmm ma'am Ara we salute ur courage nd we dey wait for d album bcos we knw sey d tin go make sense die...

No comments: