Thursday, June 9, 2016

GHEN GHEN FG WAN START HOME -GROWN SCHOOL FEEDING PROGRAMME

Nigeria's first national Home Grown School Feeding programme wey go affect about 5.5m Nigerians for first year wen e go start nahin go begin shelle for some states. Vice Presido Yemi Osinbajo yan dis wan yesterday. Vp still con dey yan say before den do The programme den go first arrange one Stakeholders Forum for Aso Rock today. Professor Osinbajo yan say the administration don dey the last level to take start the project.
School Children go dey chop beta food wey go make hunger run from dem and dem go fit read wella, farmers for the community go still enjoy as dem go dey sell dey sell dem market give the schools plus pipu wey go dey cook the food give dem and dey package am wey go still enjoy from the plan.

No comments: