Thursday, June 2, 2016

NA BARCA FOR LIFE TINS O...OLAMIDE


Miss Simplicity - Our baddest rapper for naija, Olamide don take him time take baff him pikin sef wit love too o as him post pinshure of him boy pikin for where him take dress for Barcelona outfit o. Baddest Olamide write on top ham sey " Barca for life" nd wit d way he take do for d pinshure wey him nd him pikin take, we go knw sey dis man o, him love him pikin wella oooo... Dis kind tori dey totori my body, e dey make me dey remember how my papa sef dey carry me nd my sista like egg since we dey small nd hw pipu even our mama sef take dey call us Papa's Girls wen we dey small... Yes oooo shout out to all those papa nd mama dem wey get genuine love for their pikin dem.... See Olamide pikin pinshure afta d cut...



No comments: