If you roll wella for gospel music circle for Naija, especially Ibadan, you must sabi the popular singer, Ibironke Adeniji, before she marry late last year come turn Mrs. Ibironke Bashorun. Apart from say Ibironke dey sing, dey drop album, she still be choir Oga for the full Livingspring Chapel International for the full world and pipu wey Sabi her wella, go yarn you say she be woman like man cos her ginger no be here. Her tori wey she don take style turn to ministry na wetin everybody sabi say IB (as her padis dey call am) marry above 40 years wey she don dey for life. I believe una sabi say any woman for we area here wey Neva marry by dat time go don confuse (seeseemore pinshure below)
for life. So as God don come do am, na him she do abracadabra turn her story to ministry as she don start to encourage women wey don pass 30 wey never marry, maybe dem don born before abi dem never born. The thing first start like play for Whatsapp group and now dem don turn am to ministry as she gather beta women for Lagos last week for Livingspring Chapel, Ikeja and some other ministers like Shola Allyson and co join am for programme, wey make senses. We say congratulobia to IB as she don get mind to take her life tori bless other pipu.












No comments:
Post a Comment