Sunday, June 12, 2016

(FOTO) DJ SECXY DON READY TO CLEAR WE DOUBT AS HE DON SHOOT 'NO DOUBT' VIDEO

King David Secxy wey be one of the fine boy, se our Bros DJ for Naija wey take Ibadan do him kaba, just sama us some badt jams back to back for time wey no too tey, and as he see say pipu dey feel the song, na him make am wan carry am go anoda level, cos he don ready to drop video for one of dem. The track, No Doubt where he for feature Ceeboi,Jayru,Efa n Bk and as per say he dey rep I city wella, na for Ibadan dem shoot the video and na lucas Reid shoot am. When TPN ask DJ Secxy wetin make we dey expect, he say we go shock wetin we go see for the video, as he don ready to blow we mind. Oya na, we dey wait boss. See more pinshures afta the cut

No comments: