Thursday, June 16, 2016

(FOTO) CHAIII... DIS PINSHURE FIT MAKE UNA REGRET SAY DEM BORN YOU FOR NAIJA

Chai... All dis kain thing for make person regret say dem born am for Naija. This pinshures dey waka on top social media say this Papas na wey dey do Aluta sake of say Imo State Government no gree pay dem pension for 36 months, na so dem dey fall, dey collapse for where dem dey do Aluta. Na so Nurses dey hustle to bring dem come back life. Hmmm.... as dem owe for Imo na so dem owe salary plus pension for many states for Naija. Make God help us.

No comments: