One police sergeant, Daniel Osaimayu, na him dem don pursue sake of say he collect 50k roger from moto pipu for Oshodi area of Lagos State. Tori yarn us say Osaimayu bin dey attach to Lagos State Task Force on Environmental and Special Offences (Enforcement) Unit, Alausa, and dem catch am on Monday by the X-Squad of the Lagos State Police Command. We hear say X-Squad pipu bin catch one bad guy come see money for him body. Na so that one go tall say one of the Police for the area na him guy man wey dem dey arrange paroles together. The state Commissioner of Police, Fatai Owoseni, wey confirm say na true dem pursue dem on Wednesday, say dem still pursue 4 other policemen on top say dem dey collect roger and dem no dress well. Dem names na Samuel Ando, Michael Adeoya, Richard Ugwu and Sulaiman Muhammed. Dem pursue Adeoya sake of say he wear slippers on duty, and Muhammed sake of say him dey wear police uniform when he dey on duty.
No comments:
Post a Comment