The Federal Government yesterday don yan say den never comot mind ontop negotiations with the new militant group, the Niger Delta Avengers, plus say feseral hovernment go use every opportunity wey dey available for negotiation sake of say the group go fit stop all the gboa gboa otop oil pipe lines for den tamak.
The Minister of State for Petroleum Resources, Mr. Ibe Kachikwu, yan this one for the South-South Town Hall Meeting wey den do for the Le Meridien Ibom Hotels plus Golf Resort inside Uyo, Akwa Ibom State. Kachikwu stil con dey tok say no wia for this world wey den go take fight settle mata finish finish, E con dey yan say hin job as the minister of state for petroleum na to protect oil production plus to generate more revenue for the government. He yan say negotiate wey government wan negotiate with the militant group so no mean say govrnment no sabi wetin dem fit do but say make peace reign and say na beta beta things government dey find for the pipu.
Tuesday, June 14, 2016
FG STILL DEY READY TO FOLLOW AVENGERS YARN– KACHIKWU
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment