Tuesday, March 18, 2014

25 NEW JUDGES DON ENTER THE BACKGROUND FOR WE COURT OF APPEAL


Uncle Jona don gree make dem add 25 new Judges join the ones wey first dey for our Court of Appeal o, Na the Oga wey dey form Director of Information for the National Judicial Council, Mr. Soji Oye loud the mata yesterday and he say na dem Council do the pull out and na Mama CJN, Mariam Mukthar head the council for the mata.


Dem say the New Judges go make the number of dem Court of Appeal Judges 90 now, cos the number been don go down well well as per say many of dem don die, many don retire and many don eleveate enter supreme court.

So na on Monday the 24th of March dem go swear for them for inside Supreme Court Main Auditorium for Abuja. The names of the new judges too plenty o, go check newspaper if u wan know dem. We say Congratulobia to dem all.

No comments: