Friday, June 3, 2016

DEM CUT WOMAN HEAD FOR KANO SAY SHE YARN DUST AGAINST ISLAM

Muslims youths wey dey vex for Kano on Thursday nahin dem behead one woman wey be trader ontop say she yan dust about Prophet Muhammad. The woman, wey dem say be Igbo nahin dem say she yan dust for one religious argument for Wambai market.  The woman, wey dem no greee mention her name nahin dey sell plastics for one local market. Tori yan say she bin dey with her boo wen den attack am. The Public Relations Officer of the Kano Police Command, DSP Musa Magaji, confirm the mata E still con dey yan say na the police wey enta the place ontime nahim make dem dey able to save the boo.

No comments: