One person wey dey share letter ontop Okada, wey nobody don sabi na him don kpain when he go take him Okada jam truck wey dem pack for Oworonshoki side for Third Mainland Bridge, Lagos State. Tori yarn us say the man wey dey on top Bajaj okada, wey get number plate XR 190 LSR, dey go back home afta work around 7pm on Monday when the bad thing shele. We hear say officials of the Lagos State Traffic Management Authority, wey come clear the place come halla the State Environmental Health Monitoring Unit make dem come carry the body of the person wey kpain. One LASTMA official, wey see the thing as e shele, say na sake of say the man too dey run cause the accident. Na for there him head scatter and na immediately he kpain.
No comments:
Post a Comment