Wednesday, June 15, 2016

ONTOP RENT GBESE..... TENANT CARRY HAMMER WHOZ HIN CARETAKER HEAD

One 26-year-old man, Lucky Aigbogun, na him dem say he carry hammer scatter him caretaker head on top say he never pay hin rent. When police show him face for court on Monday he say na lie o. Aigbogun, wey dey stay for Shola Martins Street, Agege, dey before one Ikeja magistrates' court. Police wey carry am come court say Essien Ndarake, yarn the court say the guy do the bad thing on June 1. He say Aigbogun do him caretaker, Morakinyo Sunday, strong thing when he flog am carry hammer whoz hin head join.  Ndarake say the caretaker go Aigbogun office go ask for the rent wey he dey owe when the thing shele. Dem say Aigbogun first lock the caretaker for one room, flog am wella, but when that one no do am, he go carry hammer whoz hin head. Na when he see blood he free am, make he dey go. The magistrate, Mrs E. Kubeinje, sha give am bail for N100,000 with two sureties for the same money.

No comments: