Monday, October 26, 2015

GHEN GHEN...2 BLOGGERS FOR IBADAN DEY YABB DEMSELF ON TOP WANDE COAL ALBUM

See gbege o, Wande Coal drop him album for Lagos, the WANTED album don burst kasala for Ibadan o. 2 respected Naija bloggers wey dey take Ibadan do dem dommot, Sirkenayo plus Real Pussiness don take am personal with eachother. Na jejely I siddon for my house wey I see the drama for BBM. Na Real Pussiness send the broadcast wey dey up, I believe say he don see something ni wey make am send dat kain BC. But Sirkenayo no gree o, him take am personal finish when he change in profile message wey dey number 2. Na so Pussiness too vex say SirKenayo na broke ass blogger, he take oyinbo yab am...na so the mata continue like season film. Abeg help me beg dem two o, make dem relax o, cos I believe say according to Lagbaja, me and you no be enemy we suppose to be family na wetin you dey find, I dey find. Lobatan

No comments: