
Wednesday, September 30, 2015
U.I. NO DEY CARRY LAST, NA JAW WAR DEM WAN TAKE CELEBRATE DEM GRADUATION DIS YEAR
Greatest UI, no dey gree carry last, especially when we dey talk of brain mata, even if dem no dey first 700 university for the world. But dem sha no dey gree, dat na why dem don polongo say JAW WAR, wey be debate go join one of the plenty things wey dem wan take celebrate dem convocation dis year. Na the Literary and Debate Society for UI dey arrange am and na today dem go start come do the final for November when the convocation gangan go dey shele. Dem go dey yarn about solutions for we Wahala for Africa.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment