Monday, October 26, 2015
NEW OONI DON SHOW O, HE NEVA PASS 40 YEARS FOR AGE
See as God dey work o, dem don polongo the persin wey Oracle choose as the persin wey go siddon upon the throne of Ooni for Ife Kingdom. Since Ooni Okunade Sijuwade cross the river go meet him forefathers na since den we don dey hear different tori say pipu don dey do different kuru kere movement to take make sure say na dem be the King. But na yesterday oracle throway one statement through the Gomina for Osun State say oracle don pick one Prince Adeyeye Enitan Ogunwusi wey neva chop pass 40 Christmas for life and him na from Girisi House wey dey Ife. The former bros wey don turn Royal Highness now na Accountant wey get ICAN plus Institute of Management certificate. So we say Kaabiyessiii ooo.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment