MISS SIMPLICITY - Doris wey be one actress wey dey rock d Yoruba movie industry wit her correct acting, bin divorce her husband Daniel Ademinokan for 2010 nd dat time, d actress bin tok sey na Stella Damascus o naim scatter her marriage. Afta many yrs nd afta all d tin wey many pipu don tok sey no be Stella cause d divorce, Doris Simeon still get ham for mind o. For one interview Doris still tok ham sey she o, no fit follow Stella tok o nd she no fit follow her work on top sey she still dey see Stella as d person wey make her no get husband now. Wen dem ask Doris sey weda she go still go back go marry her husband, Doris sey lailai o, she tok sey na only her pikin she wan collect from her husband.... Hmmm.....no comment
No comments:
Post a Comment