Monday, October 26, 2015
DEXTERITY YAFF VEX O COS NA BIG BIG PIPU HE DEY CARRY COME IBADAN FOR HIM 10TH ANNIVERSARY
Ibadan go collect some kain visitors wey go make am shake this Wednesday, October 28th cos na that day Dexterity Plus wey dey decorate anything go dey celebrate him 10 years anniversary and na dat day be him all white parry wey go shele for Hall of Grace wey dey Jogor Center. The show go make brain die cos the pipu wey Dexterity dey carry come no be shere shere, as plenty pipu don dey show dem love dey use dem DP I don see some celebs like Tope Alabi, Ali Baba, Big Bolaji plus some others for pipu dp. The show go tuff cos e be like say na the full city dem dey expect cos dem even dey polongo the mata for radio. Happy Anniversary to Dexterity plus all him customers for Ibadan and other places.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment