Tuesday, April 12, 2016

LAGOS - CALABAR RAILWAY: NO DEY MAKE PRESS YAB US ANYHOW... NATIONAL ASSEMBLY PARA FOR PRESIDENCY

Chairmo, House Committee on Appropriation, Abdulmumin Jibrin, throway reports say National Assembly commot Lagos-Calabar Railway line project from dem 2016 budget wey President Muhammadu Buhari carry give dem. Hon. Jibrin say e neva reach quarrel, make presido just yarn Naija pipu where the project dey for inside we budget. The politician from Kano climb him Twitter handle, @AbdulAbmJ, he say he shock say na the removal be headline for some newspaper, but if to say dem do chikini research ni,  e for help dem. He say Lagos-Calabar Railway line no dey inside budget wey dem Executive pipu send give dem. So how be come be say na NASS commot am. He say na dem press pipu dey yab pass for every mata,  especially when dem dey talk get mata. He say all dis nonsense on top budget mata no be dem fault O. Tori yarn us say civic tech organisation, BudgiT Nigeria, fit confirm am O,  say Lagos-Calabar rail no show at all for inside the 2016Budget wey our presido submit.

No comments: