Saturday, October 24, 2015

PASTOR CHRIS OYAKHILOME DONATE 1 BILLION NAIRA GIVE BENSON IDAHOSA UNIVERSITY

Siddon for there make dem dey lie for you say money no dey dis country o. E be like electric shock when I hear am yesterday say Pastor Chris Oyakhilome wey be Presido of Christ Love World, wey evebody sabi as Christ Embassy donate 1 Billion Naira give Benson Idahosa University for Benin City for the special convocation ceremony wey dem do for am yesterday for dem school. Dem Oga patapata when he dey yarn for the event say dem arrange am to let am plus the full world sabi say dem dey respect and honour am wella for even him dommot. 1 Billion Naira no be small money o, make God sha bless all of us, make e for no cause quarel.

No comments: