Six suspected kidnappers follow Anambra State Police
Anti-Robbery Squad, SARS, do action film o for Okpoko wey dey Ogbaru local
government area on the 9th of November but SARA fall 3 of the badt
guys and the police fir rescue Mrs. Edith Maduekwe, who dem bin don kidnap. Na
since October 4th dem don kidnap am for Oba
for Idemili South LGA, and na for one erosion site for Oraukwu for Idemili
North local government area for the state.
After the shoot out wey be like commando film, na N776, 000,
one AK-47 rifle plus 90 better bullet, one pump action gun and 10 live cartridges
including different kain of juju and otumapo dem see collect from the badt guys
hand.
The family bin don pay N1.4 millionwey dem kidnappers ask for,
wen dem dey show dem face yesterday, police megaphone for Anambra State Mr.
Uche Ezeh say e don tey wey dem don dey find the Big Boss of the bad guys. He
say na one person come do ofofo for dem wey make dem SARS oga, Mr. James
Nwafor, who be Chief Superintendent of
Police, CSP, carry him men go the place for Okpoko, where the suspects for dey
share dem buruji. And as soon as dem sight the police na so dem begin the
action film where 3 of the bad guys for fall.

No comments:
Post a Comment