We Nigerian government don yan say den go begin dey colet applications online for positions for the 500,000 Direct Teacher Jobs Scheme, through one internet portal. The gist wey bin comot from the mouth of spokesman for Vice President Yemi Osinbajo, Laolu Akande, nahin dey yan say the portal, npower.gov.ng go dey live on Saturday, June 11. The presidency yan say applications go begin enta from June 12, wey be next week den con advised young unemployed Nigerians say make den visit the website and apply. President Muhammadu Buhari for hin May 29 Democracy Day broadcast to the nation,nahin E launch the social investment programmes wey don already dey ground gidigba for the 2016 Appropriation by the administration.

No comments:
Post a Comment