Tuesday, May 10, 2016

WOW…MOBIDOC DON SAMA US MOBILE APP, WHERE WE GO DEY CONSULT DOCTOR

Everybody sabi say number of patient to Doctor for Naija no tally and dat na why pipu dey kpain anyhow bcos to see doctor no be small gbege , dat na nwhy many pipu dey try help demself, dey take drug for demself by demself wey dem take dey woundjure abi even kill demself.  As e come be say over 67% of Naija pipu get phones na like 38% of dem get internet, so e go make sense if we fit use Information Communication Technology take improve how naija pipu dey find beta health and how health care service for Naija go make sense .


Na on top dis mata, Hamid Adediran, wey be Medical Doctor, Communications Consultant plus Broadcaster don reason one solution, wey dem call MOBIDOC, nah in dem wan take stop the gbege wey dey shele between Doctors and patients wey get health palava. The Mobile App wey dem go soon launch go reduce time wey patients take dey wait , go reduce plenty number of pipu wey dey gather for health facility, go make yarnings flow well between Doctor and Patient and to come finish work, e go protect secret of every patient wey oyinbo dey call privacy.


When dem ask am, wetin make am reason dis kain beta thing, hameed, wey him guy name na MEDICASTER say na sake of say some friends and family dey always ask am plenty questions on dem health mata on social meida. So with this App, everybody wey get internet go fit get the opportunity to sabi as e dey go. When dem come ask am say hope the thing no go tear pocket, the broadly wey finish from University of Ibadan say lailai, the service no go cost money pass the money wey person go take buy data put for him phone abi any other thing wey he or she take dey browse. Dr Adediran, wey be the founder/initiator of the ogbonge health mata mobile application confirm say MOBIDOC na foe everybody o and the thing go fit run on top Android, iOS plus Windows platform. And as e dey for mobile, na so e still get desktop web options and na 247 dem dey open. Dr. Adediran say dem don ready to make things happen for we health sector for Naija, and dem wan create world where e go too easy for anybody to collect Doctor opinion anywhere, anyday, anytime . Dem say as New naija dey show, health sector no dey carry last bcos MOBIDOC don show. 

No comments: