Two judges wey dem.name be Alih Okeme and Timothy Alih, wey dey Kogi State Judiciary don disappear as some big bros wey nobody sabi carry dem go yeasrerday. Tori yan say na yesterday dem carry the two of them but na for different place still for inside Kogi State.. tori still com dey gist say Hon Alih Okeme na hin the big bross dem carry for Ojuwo Ocha along Idah-Ajegwu-Lokoja road, while hin colleague, Hon Timothy Alih, dem lift am for Ayingba, Dekina local government. State Police Public Relation Officer, ASP William Ayah , when hin dey confirm the gbege com yan say make evry body wullop say dem don bigin make plan as dem go take bring dem bak
No comments:
Post a Comment