I shock when I see for my Facebook page one post say APC DON carry dem official lie wey Oyinbo dey call propaganda come gain O, one of my friends for Facebook na him post dis girl picture, say he wonder how person go do 2 years for Sambisa Forest come still clean like dis, he say shey dem sure say na for Sambisa dem pick am abi one EMIR' Palace. Wetin he write surprise me, but wetin come shock me be the number of pipu wey don comment and don share the message, many of dem say dem wonder which kain lie APC DON carry come again to celebrate dem for at year for office O.... To come make mata go anoda level, dem say dem don find anoda one again. Walahitalahi the mata confuse me abi wetin una think?

No comments:
Post a Comment