Miss Simplicity - Na wit correct happiness naim Aralola Olumuyiwa wey we knw as Ara take dey her fans sey PBA Enitan Ogunwusi wey be d Ooni of Ife don make her d Cultural Ambassador for Ife Kingdom o. Ara wey get beta talent to dey beat drum naim post d news for her Facebook page o nd she put sum pinshures join wit beta appreciation message o. She tok sey " She dey thank Oba Adeyeye Babatunde Enitan for d appointment o. She tok sey words no go fit reach for her to take express how her belle sweet reach o... Ara tok sey dis appointment na encouragement e be to her o base on sey dis one now go com make her dey do her best to dey promote our culture, she promise sey she go make Yoruba pipu infact d whole ogbodo naija proud o nd she come still thank Baba God for dis honour wey He give her.Last last Ara come tok sey o make God o, make Him dey bless d king wella o...Me I follow tok sey Amen to d prayer o nd all of us wey dey TPN dey tok sey congratulation to u ma'am...See pinshures nd certificate afta the cut
d appointment leta afta d cut....
No comments:
Post a Comment