Sunday, October 18, 2015

EEDRIS ABDULKAREEM TAKE PRESIDENT BUHARI ROB AM ON STAGE FOR FELABRATION

Broda Eedris the Oko Ashawo himself don start again o, he like to dey gbege government and everybody don sabi say quarrel na one of him selling point. Na so he climb stage again for Felabration say na President Muhammadu Buhari wey kill Fela come still dey rule Naija. Make we no forget say na Buhari carry Fela go Court that year, go jail am for 5 years cos na Sai Baba be the Minister for Petroleum dat year when 2.8 Billion Naira oil money waka miss wey make Fela sing Army Arrangement. Dem say Femi Kuti try run go pause Eedris mouth but before he reach there, Eedris don open him mouth like Basketmouth, say we Presido na killer, na him kill Fela. Make we see if Buhari go talk abi he go bone.

No comments: