Miss Simplicity - E be like sey Tiwa Salvage don by herself blow final whistle for d business relationship wey dey between her nd Don Jazzy nd mavins record get o as she don do kele kele take end d contract wey dey btw dem o.
Na one insider naim dey tok d tori out o sey d mavins queen don do kele kele comot for mavins record o base on sey all d records nd projects wey she dey do now, na her moni she take dey do dem o.
Hmmm make e no be like sey we too dey fast-forward abi we too dey form tins, e go beta make we wait for Tiwa nd Don Jazzy to come announce dis tin officially o.....

Tuesday, May 24, 2016
HMMM... E BE LIKE SAY TIWA DON DEY KAWASAKA FROM MOVIE RECORDS
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment