Thursday, June 2, 2016

TWO PDP HOUSE MEMBERS DON PORT ENTA APC

Two member for Peoples Democratic Party (PDP) for the House of Representatives don port go the ruling All Progressives Congress (APC). For separate letter, wey dem read on the floor of the House, the lawmakers, one wey com from Anambra State, Tony Nwoye plus the other wey bin com from Benue State, Emmanuel Udende, yan the House say dem dey gerara hia  from PDP sake of say the kasala wey dey shelle for the party. The Minority Leader of the House, Representative Leo Ogor, con, reject the port con still swear say the pary go carry legal action ontop the two lawmakers. He yan say no institution like court don confam dem port or confam say the pary don break into two. But Dogara yan say no need to dey debate the matter because say issue of PDP go dey solve for  the national level.

No comments: