Tuesday, May 24, 2016

PEKELE PEKELE... DEM SEE 52 YEAR OLD MAN DEAD BODY INSIDE WELLA FOR LAGOS

One 52-year-old man, Ishaku Lawal, don port go heaven wen E dey clear one an abandoned well for Liasu Road, for inside Idimu area for Lagos State. Tori yan say Lawal nahin pipu wey dey the area call say makehin com elep dem clear the well sake of say water go dey inside well but the victim nahin dem say nak hin head for one stone inside the well com died instantly. Officials for the Lagos State Fire Service, wey dem invite to the scene, na dem  removed the body. The Director of the Lagos State Fire Service, Razak Fadipe, yan say investigation show say the well don dey abandoned for a long time. He still dey yan, say The pipu for the house, think say dem fit clean am sake of say dem go see clean water fetch. Lawal, wey be Hausa man, done dey half way wen E nak hin head for well he com dey yan the pipu say. make dem ask government for  support anytime dem wan do dis kain thing .

No comments: