Saturday, May 21, 2016

SEE GOBE... BADT GUYS DON KIDNAP KWARA APC CHAIRMO AND DEM SECRETARY

Kwara State Chairmo for APC, Alhaji Ishola Fulani-Balogun, plus dem Secretary for the party, Chief Bode Adekanye, na him some badt guys wey nobody sabi don kidnap for Abuja-Lokoja Road. Tori yarn us say the 2 APC chiefo dey go back to Kwara State afta dem go attend Senate Presido, Dr. Bukola Saraki, court mata for Code of Conduct Tribunal wey shele for Abuja. Dem party Publicity Secretary, Alhaji Sulyman Buhari, confirm the mata to journalists for Ilorin. He say na call dem receive for phone from line of dem chairmo (Fulani-Balogun), yarning dem say dem don keep am. He say dem no talk money and as dem try to ask dem question reach, dem no talk and na so dem take off the phone.

No comments: