Saturday, May 21, 2016

ICPC CATCH BAD GUYS WEY DEY TAKE PRESIDO NAME 419 PIPU

As FG dey ready to sama 500 billion Naira give Naija pipu wey poverty don kolobi dem destiny, dem don polongo say make everybody dey shine dem eyes O, say some baddos wey wan create wayo job. Give dem self for wey dey claim say na Government send dem message no go do dem strong thing O by the way of 419.  The warning na him dey follow as ICPC don catch one came just as Maga, Umanah Umanah sake of say he don 419 plenty pipu wey dey find work. The ICPC for one statement by the Commissioner for Public Enlightenment, Mrs. Rasheedat Okoduwa, say the bad guy and him goons wey dey arrange the bad things together don start one wayo loan scheme wey dem call, "President Mohammadu Buhari Poverty Alleviation Programme."
NA under that aburada dem come lie give plenty pipu The say dem go give dem loan of like 1 million, but dem go pay like N5, 000 and N7, 000 take collect from. Chai.... NAIJA pipu sha.... We no dey taya???

No comments: