Friday, May 20, 2016

LADOKITES VS NURTW... KASALA BURST FOR LAUTECH TODAY

Kasala burst today for Ladoke Akintola University, (LAUTECH) as students and pipu for National Union of Road Transport Workers (NURTW) dey gbege each other.  Tori yarn us say NURTW pipu for Ogbomoso go hayaj the main gate of the school with stones and cutlass. Na so the former Students' Union Presido plus others no wan gree make dem come hayaj dem for dem dommot, na so dem start gbege too wey dem block road, close down dem school gate. The gbege serious so tey the Dean of Students' Affairs, plus School Security and other Staff for the school gats show for the place to calm dem down. But Sha O as of when we dey hear the tori nobody don talk wetin be the Genesis of the surutu.

No comments: